Thursday 12 July 2007

bush mon in jandon wan yan!!!!!!

Bloggers- i hail una,
2 be honest with y'all i no know wetin dey chop 4 my brain wey make me decide to become a blogger o cos naturally i used 2 regard people keeping dairies of their life and experiences as loners with nothing better to do..(man 2 busy now),but e be like say my view concerning dat don change.
Maybe na with age,or this frigging country(am sure its this country!!!) naim make me see sense inside blogging o..but anyho nothing spoil,make i try till i tire.

You might be wondering "why the title"?, well
let me do the maths(SAS code) 4 una:

coalease(an african +
a nigerian ,
a yoruba man )+
grew up in one of those western states /
left join(not a lag boi )
not from a rich family
masterful okader rider
cant live without sepe,paraa,mokole,opaeyin et al
dey still chop boli and epa anytime in naij(omo na aprodisiac true true o)
=bushman.....lolly abi na lol una they call am?

butwith all dat, bush man still dey le(interpretation-am hot!!!!)....
i fine pass fineboy(my guy i don c u,my peaple do do research on u),
awon idi skenkele(white ynash) they trip 4 me 2 much, left rite and center,
am young, tall,sharp dresser,fit as kilon sele
and i cum toast my way into working in one fortune 50 company like dat...(God deserves all the glory though)...

some of y'all might be thinking;
"dis guy na mugu,he's to full of himself","i bet he aint fine sef?"yadayada yadayada.

Omo fiyen le!!...
file!!!....
leave it!!..
nna,i am arogant smart sexy and a bush man that aint afraid to be himself without fronting no matter wat...abi ladieeez aint that want you like in ur men?..hey, you there -'shirt up' stop tripping,you know its true..lolly or lol

I remember those days i wuz in school back in naij(..dont i alwayz),all these lag bois go dey brag say
"you these ******* guys(fill in the space-its a city in naija),becos you live in this city you go dey buga us with ur fathers cars, come to lagos and see levels etc etc"..na me send una come school far away from home???i digress abi no b so una dey call am...

Actually to be honest with you guys, this blogging wey i wan start na 2 find wife o, my juliet,my other half,and all the jara (and all the extras). .i just cant seem to find any correct gurl in this shithole of a town i live and work in sha,na only awon omo olidi skenkele(flat ass chicks) i dey ynash for the past 7months,although one of my new acquisitions get ynash like mama africa.

Make i yarn una about am;

this chick is ynash,unbeleivably ynash,idi oke....those kind ynash that you can c from the front .on top white girl again with hazel+green eyes='to die".

I was jejeli at my desk doing my SQL and writing codes and MACROS and all when this ynash just breeze past me, the bad thing is my desk faces one of the exits on the floor so i get a lot of distraction(viewing pleasure)from my work ,you no ask why of all peaple 4 work they had to put the only black,red blooded,meat loving,ass mad,puna chopping,always horny,ever ready african man 4 this desk o(no wonder my performance assessment grades have being falling..i need to request for a change of seat) i digress again...

bushmon (upon sighting the juicy ass(et)): "Ye!!!!!!"

Oyiboman beside me(startled): "are you alright bushmon?"

bushmon(still looking at the ass disappearing fastly into the distance):"i gotta run"

when it comes to 'matters of the ass' omo am hooked o, na so i quickly chase the babe,this ass shall not pass me by 2days,me whey i neva kele in 10 days 6hrs and 15minutes i need to start re-programming.

na so i chase the girl half running half walking.

by the time i reach the babe mo ti shape up,put on my charming face my mama gave me ready for action;

Bushmon: "hi"

White bakassi: "Hello there"

Bushmon: "i just lost 1 weeks worth of data..your behind just got me into trouble"

White bakassi: (dumbfounded)"sorry?"

Bushmon: "my name is bushmon...are you new"

White bakassi:"Yeah i just started today"

bushmon:"i probably shouldnt have uttered wot i said earlier but its true,and i like being honest"

white bakassi:"its ok,..ehm do u know where the canteen is"
bushmon:"its on the first floor..hey actually havnt had lunch 2,u need some company??(na lie i don chop rice and beans)"
white bakassi:"ehm...ok"

as we dey yan dey go canteen nai i dey take style the check the baby out o...
age-21 or 22,ass-woah!!(check),lips-thick enuf!!(check),height-5inch 4(check),figure-orekelewa!!(check),good dentition(check)
..BINGO!!!!..she dis one no pass my size o(small complex wan catch me)

anyho sha the baby come they gist me..she be american..half white,half latino(me thinking:ope o...that's where the ass emanated from),
did her bsc in cambridge,
just started her graduate program at my company(awoof),
dated a black guy before(anoda bingo!!!) etc etc

My peeps na so we dey jist 4 canteen past lunch time o that i forgot my work...e,oyibo girl wey dey laff to my naija jokes?,mo gbodo pari ise yi(i gotta finish this course),while she was yarning and me nodding my head and looking attentive enuf,i come dey think;

..."this girl too fine","i have to have her","kiss her lips","eat her" "and she's digging my yarns sef"...different bad tots just dey enter my mind..
"damn am getting sprung"...
"not paying attention again"..
."devil i bind u"....
"still sprung"...
"try reciting 13 times table"...
"13X1 13, 13x2 26,13x3 i don forget"still sprung her voice alone na maga".
mogbe!!!(am doomed),"the canteen is closing,we have to get up now"
...ive gotten super sprung............

(2 b contd)